Situation Room - Erigga

Situation Room

Erigga

00:00

03:51

Similar recommendations

Lyric

Abeg

Paper, Paperboi

2019 mhen, how e be?

(Brenny Jones ti de o)

I wan give you story now from the situation room

(King Paper)

How e take happen for area real, real

Just now, just now here e never too tey

I be ghetto boy and I like to chop money (chop money there)

Iji ego, I like too much money

I still like dem type Adeleke money

(Adeleke money)

Plus Otedola, all that kind money

(biggie biggie money)

Oh, (kpakam)

If I make this money (kpakam)

I go buy full Lekki (kpakam)

If I make this money (kpakam)

I go buy Ferrari (kpakam)

If I make this money (kpakam), (eh ehn guy how far?)

I go flex my mama (kpakam), (that matter wey I say I wan clear you)

If I make this money (kpakam),

(eh ehn na this so ma just clear you now for this yarn)

I go spend this money

E get one matter when play

You know my guy Sparko?

That my tall, black guy when dey stay airport road

No be small matter happen for area o

As I dey follow you talk dey yarn, four person don go

Dem say dem get one transaction

wen be say dem do

Abi na one million dollars when dem say somebody chew

The matter be say, the guy dey work client tey

Na im make dem run money for the client, make she pay

When money finish, dem wan come die the money

For this small Warri, dem wan guy the smallie

Some kind brah for the area, dem be deadly

No need to give dem money, buy two Benelyne

Dem don enter motor dey go find the pick up

Two kala cut to size, all of them kit up

One dey hurry so tey e cock him gun down

Enter speed breaker, he mistakenly gun him own man for front seater

Driver don confuse

Don turn him hand, no dey face road

The kind trailer when jam dem comot

Na those kind trailer when-when dey carry load

Oh, (kpakam)

If I make this money (kpakam)

I go buy full Lekki (kpakam)

If I make this money (kpakam)

I go buy Ferrari (kpakam)

If I make this money (kpakam)

I go flex my mama (kpakam)

If I make this money (kpakam)

I go spend this money

So I pray, I pray gan-gan

I pray, I pray

So one day, one day, one day

Hustle go pay, e go pay, I pray

Oluwa I dey pray

For this life ehn, no be who get money now get money

You no know all those bank gate men?

You know how much dem get when them dey their twenties?

You go hustle after you say your morning Amen

Four of them laugh, them dey drive dey go

Dey reason life, some of them don spark their kpo

Dey think wetin dem go do once the money show

One say music, the rest say na ashawo

Or go downtown buy all their men ibo

You no fit blame them, na the only thing when them know

Na there one say "po-po fit dey around"

So e cock, e cock, e cock e kala down

Be like say the nose face the guy for front sit

See police for front, the guy halla "shit" (Oh shit!)

Him no see the speed breaker, him jam am kpoo

Accidental discharge, he own man kpoof

Before now him say

If he make this money, kpakam

Him go buy Bugatti, kpakam

Him go take the money kpakam

Buy everything, kpakam

Before him hear gbagaun

The man don go, where him take gbagam

Him no believe him Bible

So I pray, I pray gan-gan (na real matter)

I pray, I pray (confirm matter, legit matter)

So one day, one day, one day (omo na prayer matter)

Hustle go pay, e go pay (abeg)

I pray (spiritual)

Oluwa I dey pray

We dey pray Oluwa

Untimely death no be our portion

Give us e.t.c money oh

Money wey no get finish, fete rise, fetera type of money

Na so e just be mhen

I fit carry you reach the water

But na for you to learn how to swim

Motivate yourself

- It's already the end -