Welcome to Warri - Erigga

Welcome to Warri

Erigga

00:00

03:55

Song Introduction

Erigga’s hit single “Welcome to Warri” is a vibrant homage to his hometown in Nigeria. Blending traditional Nigerian rhythms with modern hip-hop beats, the song highlights the rich culture and resilient spirit of Warri’s residents. Released to widespread acclaim, “Welcome to Warri” has resonated with fans both locally and internationally, showcasing Erigga’s lyrical prowess and ability to fuse diverse musical influences. The track not only celebrates Warri’s unique identity but also underscores Erigga’s role in elevating Nigerian music on the global stage.

Similar recommendations

Lyric

Yes

I dey always dey tell people say

For this town we get three different community

Ekpan, Agbasa, & Okere

Agbasa- If dem hold you say you thief phone,

You dey pay for stabiliser and phone

Okere - If them hold you till day break

Na bottom stairs you dey sleep

But Ekpan - If dem wan give you post

Dem no dey look say you be indigene

Na the kind mark wey dey

Your body dem take dey give you position:

If you get one eye you be vice

If your hand dey seize you be P.R.O

If you get bullet mark you Be D.C

If you waka dey wave you be press

Area I hail oooooo! (Old Warri)

Welcome to Warri where all the Mama's dey vex

F*ck up no dey sawa

She tattoo am for her brezz

Her son dey press

Two kala under her dress

She ready shoot Olokpa if them come her address (Rest)

No be today she don dey see her arrest

Area Mama for the hood you no wan see her vex

Apart from cocaine nothing Mama no dey sell

1999 dem lock Mama throw her inside cell

Dem carry her pass me where I for dey play "Monkey Post"

They almost blast me with slap,

I take off with my Kitto's

The first time I see where dem stab person neck

Na '94 two seconds naso andrew fall

Andrew Mama dey bust cry

Who do am don Run

Full compound dey pack "Egbe The Police" dey come

You suppose know Egbe

That guy matter na dead

Him fit arrest the full area if e enter him head

I no be mumu Aje

I know the area well

Full Agbasa, Igbudu dem know my matter there

Odumu, Sobo, Ejegba we get house for Ekpan

Go Udu, Oruvworun

The hands sound

I no Be mumu Aje

I know the Area well

Warri Crisis '99 I dey there

Marine gate, Iyara

We Get House for Ekpan

Go Ogborikoko

Ask na

The hands sound

Dem butcher my friend hand for "Agbasa Feast"

With old cutlass na so fight take enter Street

Igbo Market men dey run enter people shop

Carry 2 Wrong Set Of Shoes till the feast stop

Police dey shout: "If you move..."

I no fit stop!

Follow me enter Ejegba I enter you top

Our biggest fright na Ekpan Hilux Light for night

Those men no get joy beating na their appetite

I dey ceiling when dem carry all my guys go

Government bangle for the hand let the dice roll

Papa dey waka police matter 3 weeks straight

Native Doctor and Pastor for here dey lick plate

Imagine say the full area no get Big Man

Wetin concern signboard and who dey sell weed? Man

Dry Bread and Sadine plus Igbe Fanta

Naim we dey chop after we don smoke for downtown

I no be mumu Aje

I know the area well

Full Agbasa, Igbudu dem know my matter there

Odumu, Sobo, Ejegba We Get House for Ekpan

Go Udu, Oruvworun

The hands sound

I No Be mumu Aje

I know the area well

Warri Crisis '99 I dey there

Marine Gate, Iyara

We Get House for Ekpan

Go Ogborikoko

Ask na

The hands sound

Yes na so e be for the same Warri where We Dey Area and Characters:

Iyara - NairaBet

Isido - Vigilante

Obire - D.J

Ereku - Dustbin

Ogedegbee - Waka well

Pesu - Confra Boys

Victory Avenue - Beggi Beggi

Hausa Quarters - Ole chains

Garage - Ticket

Oppe - Gamblers

Ometa - No Neighbor

Agbasa - No Company

Ogunu - No Market

Makaiva - Gbo Gbo

Okere - Juju

Ajamoga - Link Road

NPA - Diesel

Ogbangwe - Judgi Judgi

Avenue - Depot

Airport Road - Ole

Ekpan - Murder

(Abeg)

Day break everywhere bust men

It's the "Erigma 2"

I Know for waited 7 years for dis men

Guess what? You no wait in vein a swear

Burst una screen guard

(No Limit)

All the jam dey bang

Abeg commot your leg for high tension ooo

- It's already the end -